FA Cup or Champions League qualification - which one important ?

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Neil Johnston
- Role, BBC Sport journalist
Nottingham Forest, Aston Villa, Crystal Palace and Manchester City, go play for di semi-finals of di FA Cup for Wembley dis weekend.
Three of di four - Forest, Villa and City - dem also try to qualify for di top-five Premier League finish dis season.
Dis top five finish go secure Champions League slot for any of dis teams next season.
But wetin important - to win di FA Cup or to qualify for di Champions League?
On Saturday, Crystal Palace go play Aston Villa for di first semi-final while
Nottingham Forest go face Manchester City for di second semi-final on Sunday.
Di winners of di final for Wembley on 17 May dey guaranteed to get a major trophy.
Dem go also play for di Europa League next season - while top-five finish for di Premier League go guarantee at least eight games for di highest club competition - di Champions League.
But which one dey important ?
Former Manchester City defender Nedum Onuoha argue say "Di chance of a trophy dey massive, regardless of anytin else wey dey happun,"
"To lifting silverware dey give truly iconic moments.
"Na di stuff wey you go . For years to come fans go di starting line-up, di squad, di managers, di run - evritin."
Major trophy - or Champions League cash?
Dis season FA Cup don produce a fair share of surprises wey lead to di semi-finals dis weekend and fans no too dey familiar wit dis fixtures
Record 14-time winners Arsenal crash out for di third round, Premier League champions-in-waiting Liverpool comot for di fourth round, while di winners of last season Manchester United lose on penalties to Fulham for Old Trafford for di fifth round.
Crystal Palace na di only one out of di four remaining teams wey neva win di FA Cup bifor.
But while Manchester City bin win two of di past six finals, e don 60 years since Aston Villa and Nottingham Forest lift di prestigious trophy.
Villa fit be seven-time winners but di last time dem win di FA Cup na for di 1956-57.
Two-time winners Forest bin win the European Cup on two occasions since di last time dem win di FA Cup for 1958-59.
Di FA Cup final, wey plenti pipo around di world dey watch global wit millions of television audience, get prestige and e dey sweet pipo belle well-well.
While di winners get to claim a major trophy in front of dia fans for di national stadium.
From a financial point of view, however, na small money compared to di riches of di Champions League.
'Winning di FA Cup is eternal'
Aston Villa don earn a total of £910,000 for FA prize money wen dem bin beat West Ham, Tottenham, Cardiff and Preston for di FA Cup dis season.
Dem receive £8.85m sake of say dem win five league phase match for di Champions League dis season.
Wen dem reach di Champions League last 16 di club also earn additional £9.27m.
But Aston Villa, Forest, City or Crystal Palace go receive just £2m for prize money if dem win di FA Cup final next month.
Forest bin play dia last match for European football premier club competition for October 1980 wen dem bin dey call am European Cup bifor dem change di name to Champions League.
Wit five games wey remain for dem to play, Nuno Espirito Santo team dey fourth for di Premier League table.
Dem get three-point gap between dem and Chelsea wey dey sixth.
"I want to romance di FA Cup trophy but Champions League football go bring a big windfall and e go offer more beta opportunities to establish a strong foundation for future success," One Forest fan Bell tell BBC Sport.
But anoda Forest fan Simon get a different view.
"Yes, European football dey bring plenti money. But to win a cup dey eternal," im tok.
"See di joy of Newcastle fans - dem go dis year more dan di year wey dem make di top four."
Onuoha add say: "Dis na pinch-yoursef moments for di Forest fans and if dem get one and not di oda, dem fit decide how dem go feel about am afta."

'We dey play to dey for top five'
Villa dey desperate for more big European nights under di floodlights afta dia memorable wins ova Bayern Munich, Bologna and Celtic.
Dem bin lose 5-4 on aggregate to Paris St-Germain for di quarter-finals, Unai Emery side must finish for di top five to play for Champions League next season.
Dem currently dey seventh, two points away from fifth and dem don play one game more dan di three teams wey dey immediately above dem.
Dia goal difference no also plenti if you compare am to dia rivals.
Villa, however, dey two wins from dia first major trophy since Brian Little team defeat Leeds United for di 1996 League Cup final.
Make dem go all-out to win di FA Cup - or na to finish for di top five be dia priority?
"Of course di Premier League na our priority," na wetin Villa boss Emery tok afta im team lose 2-1 to Manchester City on Tuesday.
"We dey play for di Premier League so dat we go dey for di in top five."
Dis weekend Villa go play dia first FA Cup semi-final for 10 years and more dan 30,000 of dia fans dey expected to showface for Wembley to see dem play Crystal Palace.
Emery add say: "E dey special to play for di semi-finals. Na somtin we achieve wit hard work. Now we must continue."
Onuoha beliv say di FA Cup semi-final na Villa biggest game of di season.
"We see wit Newcastle wetin to see your team lift silverware fit mean to ers and somtimes na once in a lifetime type of tin," im add.
"Villa go want a chance to try and lift di trophy. You fit make di case say na dia biggest game of dia whole season so far.
"I tink at times dem dey maybe take am for granted for dis modern age of di financial power of Champions League qualification.
"Di game dey massive, di players go know say e dey massive, all dos fans wey dey travel down to Wembley go know say e dey massive.
"You fit say di whole season fit ride on dis semi-final, and in some ways maybe e fit . But na so e dey be anytin you get a chance to play for silverware");