Young Nigerian mum tok wetin pregnancy take her eye see
- Author, Fiona Equere
- Role, Journalist
Martha Awereosuoghene Okedu tell BBC pidgin about her pregnancy journey.
Twenty-year-old Martha say she bin receive different negative words from pipo during her pregnancy sake of her physical body changes wey include discolouration, hyperpigmentation, and big nose.
Di content creator explain say pregnancy no be small journey for women but despite all di online bullying, she dey happy becos her pikin na di reward for her pregnancy struggles.
"I just free my mind becos I know say na beta tin make me change, na belle I get," she tok
"I born finish bifor I put anytin for social media, becos I dey see my pikin and my body don change from wen I get belle."
She tok say she bin wish say she know wetin she go face bifor she get belle, but she don happy well-well becos her body don change afta she born her pikin.
Martha advice women say dem go experience physical body change but make dem no reason am becos na temporary change.
"My advice for women wey carry belle be say, pipo go tell you words but no reason dem. Make you focus on your sef, make you forget any kind of insult wey pipo go give you, make you relax yoursef," Martha tok.
Filmed and edited by Monday Idara