Canada work permit rule wey allow foreign workers to change jobs - wetin e dey about?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di govment of Canada don introduce option wey go allow foreign workers to change dia job without waiting for work permit approvals.
Normally, foreign nationals wey wan work for Canada go need a work permit, wey be di legal document wey fit allow di pesin to get employment and receive pay from employer.
Now, Canada govment dey reduce delays for foreign workers wey dey try change dia jobs without dem waiting for work permit approval.
Meanwhile, any individual wey dey eligible to work witout a work permit go still need a Temporary Resident Visa to enta Canada.
But di new policy na to make am easy for workers to change dia jobs, grow dia careers and di financial stability of temporary foreign workers for Canada.
Categories under which foreigners fit work without approval
Foreign nationals wey dey Canada but previously get a valid work permit and apply for a new one bifor di expiry of dia previous permit. Dis dey known as 'Maintained status'.
Dem fit kontinu to work under same condition until dia new application get approvals.
Maintained status offer temporary residents di opportunity to continue dia work, but get gatz stay for Canada. If dem comot for Canada, dem no go benefit from di opportunity.
Meanwhile, foreign nationals wey dey maintained status need to stay for Canada while dia application dey under processing so dem no go lose dia authorization to work.
Also, foreigners wey get valid study permit fit work without a permit. Dem fit work off-campus and during academic breaks.
International representatives and dia family and personal staff fit work witout a permit for Canada.
Wit dis new public policy, foreigner wey get valid job offer and e don submit a work permit application, di worker dey allowed to begin employment witout delay.
Meanwhile, Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) dey reduce score of married pipo wey dey enta or wan stay for Canada but declare dia spouse as 'non-accompanying'.
Di 'non- accompanying' option dey help married workers choose if dia spouse dey come wit dem or not, if dem wan apply for di permanent residency.
How Canada 'non-accompanying' spouse option fit affect married pipo
Canada dey give skilled workers pathway to become permanent resident but if dem lie say dia spouse no dey follow dem to gain more points, e fit get serious wahala.
Di IRCC go issue one letter especially wen di spouse dey live and work for Canada. If dem find lies for di letter, e fit lead to five-year ban.
Canada Express Entry dey score applicants through di Comprehensive Ranking System (CRS) for different factors like age, language proficiency, qualifications.
Single applicants fit get more points dan dia married applicants if dia spouse qualifications and language scores no dey good enough.
But married applicants fit declare dia spouse as "non-accompanying". Dis mean say dem no go relocate to Canada as permanent residents.
Di "non-accompanying" declaration go make dem assess di applicants as single and e fit add up to 40 CSR points.
Wit Express Entry, candidates dey use di 'non-accompanying' spouse option to increase dia score.
Meanwhile, for October 2024, Canada announce say dem go reduce permanent residency targets from 395,000 for 2025, 380,000 for 2026, and 365,000 for 2027.
Dis dey make plenti married applicants to declare dia spouses as 'non-accompanying' to give dem more chances, and IRCC consida am as misrepresentation.
For Canada, misrepresentation na offence under Section 40 of di Immigration and Refugee Protection Act (IRPA), wen an applicant provide false information or no provide material facts wey fit affect an immigration decision, weda intentional or not.
Although, to declare a non-accompanying spouse dey allowed under immigration law for valid reasons, such as a spouse career abroad or family obligations, but Canada IRCC fit get issue wit am especially wen di spouse don alreadi dey for Canada on temporary status.