'I dey homeless, my 41-year-old daughter dey miss, my son dey in debt' - Nollywood actress lament

File foto of Jumoke George during one of her birthday celebration

Wia dis foto come from, Instagram/Jumoke_George

Wetin we call dis foto, File foto of Jumoke George during one of her birthday celebration

Popular Nollywood actress, Jumoke George, don tok say na inside church she dey live for about six years now.

Jumoke George for one strong emotional interview wit fellow actress Biola Adebayo on how she begin live for church six years ago, battle wit illness and a missing 41-year-old daughter.

Anchor and di owner of TalkToB show, Biola Adebayo bin ask Jumoke George why she bin hide her problem and she respond say na sake of shame and fear say di public go mock her.

Di ogbonge actress further explain say na early 2025 her health gbege bin start and sake of dat, she need cancel acting jobs wey she don kollet.

"Sometins dey wey dey embarrassing to tok but at dis point, I no get choice. I wan speak out. I dey work but no be like say I dey get jobs every time.

"Sometimes, e fit be once in three to four months. Dat na bifor I become ill. Afta I become ill, I bin no fit go for set wey I dey invited to."

Jumoke George also tok how pesin bin pay am since 2024 and she later spend di moni to treat herself afta she fall sick.

"I bin go anoda location but I no dey able to work. Dey bin bring me back sake of my health. I don do several tests. Dem do some more wey go cost about 400,000. I no know wia to get di money from."

'How I begin live inside church'

Jumoke George further narrate how she begin live inside church for about six years afta landlord evict her from her apartment sake of she no fit afford rent.

"Di house rent become high and I no fit afford am anymore. Di landlord bin tell me to leave, I beg but e no gree but wetin I wan do");